Jeff Bezos wedding picture: Lauren Sanchez dress and oda celebrities wey show for for Veni

June 28, 2025

Pictures from Jeff Bezos and Lauren Sanchez wedding for Venice

Lauren Sánchez wear Dolce & Gabbana haute couture gown while Jeff Bezos place im arm around her while e wear one smart black tuxedo

Wia dis foto come from, Instagram/Reuters

28 June 2025, 09:59 WAT
New Informate 52 minutes wey don pass

Lauren Sanchez, 55, wear one lace Dolce & Gabbana haute couture gown for her wedding to Amazon founder Jeff Bezos.

Camera capture her dey smile togeda wit Bezos, 61, after di ceremony, for one picture dem post on Instagram.

Reality stars, actors, royals and some ogbonge A-listers travel to Venice for di ogbonge wedding of Amazon founder Jeff Bezos and TV presenter Lauren Sanchez.

Oprah Winfrey, Orlando Bloom, Kylie Jenner and Ivanka Trump be some of di celebrities wey camera catch for boats and streets of di Italian city on Thursday and Friday.

Di ceremony dey expected to last three days, ending with one big party for di married couple and dia hundreds of guests on Saturday.

Di event bin attract protests from some groups for Venice, including locals wey fight over-tourism to climate change activists.

An estimated 200 pipo bin dey invited to Friday ceremony on di small island of San Giorgio, wia Matteo Bocelli – son of Italian tenor Andrea Bocelli – perform according to reports.

While di exact cost of di wedding no dey known, di estimates range from $20m (£14m) to more dan $50m.

Oprah Winfrey for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Oprah wear burgundy dress and white print. Her hair dey styled in loose waves.

Wia dis foto come from, Getty Images

Kim Kardashian for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. She dey point her index finger give pesin as she dey talk.

Wia dis foto come from, Getty Images

Kylie Jenner and Kendall Jenner for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Kendall wear one floral print dress and Kylie wearing a yellow dress.

Wia dis foto come from, Getty Images

Jeff Bezos wear dark glasses and tuxedo as e wave from di back of a small motor boat for Venice on 27 June 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

Pipo point dia cameras toward Jeff Bezos (not pictured) and guests, as dem spot dem from one boat for Venice.

Wia dis foto come from, EPA

General view of Venice, Italy, during di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Gondolas dey dis picture ontop di water.

Wia dis foto come from, Getty Images

Khloé Kardashian and Kris Jenner for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Khloe wear sleeveless black dress and Kris wear a leopard print dress.

Wia dis foto come from, Getty Images

US singer-songwriter Usher Raymond IV (L) with American football star Tom Brady - Usher wear a grey check suit and black bow tie, Brady wear a black suit, dark navy tie and dark glasses, and both dey inside boat.

Wia dis foto come from, Getty Images

Activists dey protest for Venice, Italy, against tdi wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Dem hold posters wey say "We be di 99% We get di power".

Wia dis foto come from, Getty Images

Activists dey protest for Venice, Italy, against di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. One protester carry flag for di pictured as e try to climb column.

Wia dis foto come from, Getty Images

US manager Corey Gamble and US television personality Kris Jenner for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Both of dem wear black outfits and sunglasses.

Wia dis foto come from, Getty Images

Kris Jenner, Khloe Kardashian and Kim Kardashian for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Dem do di peace signs ontop a taxi boat while dia mother Kris Jenner take dia pictures.

Wia dis foto come from, Getty Images

Edward Enninful and Vittoria Ceretti for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Edward wearing one bright white suit and Vittoria wear a pastel pink coloured gown.

Wia dis foto come from, Getty Images

US tech entrepreneur Bill Gates and im partner Paula Hurd for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Both wearing black outfits.

Wia dis foto come from, Getty Images

US actor Leonardo Dicaprio in Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. E wear a dark baseball cap wey partially cover im face.

Wia dis foto come from, Getty Images

British actor Orlando Bloom wear white shirt and cream-coloured trousers in Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez.

Wia dis foto come from, Getty Images

Ivanka Trump and her husband Jared Kushner in Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Ivanka wear pink dress and Jared wear suit and bow tie.

Wia dis foto come from, Reuters

Amazon founder Jeff Bezos and Lauren Sanchez make sign from di taxi boat for di Aman Hotel for Venice on June 26, 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

 

Search

RECENT PRESS RELEASES

Go to Top