Michigan church shooting: Gunman attack The Church of Jesus Christ of Latter-day Saints, k

September 29, 2025

Wetin we know as gunman attack, burn The Church of Jesus Christ of Latter-day Saints for America

Dem no support media player for your device
    • Author, Nadine Yousif
    • Role,
  • 29 September 2025, 09:52 WAT
    New Informate 32 minutes wey don pass

At least four pipo don die and eight odas injure afta one gunman drive motor enta one Michigan church, e open fire and set di building one fire, police tok.

Officials tok say di attack on The Church of Jesus Christ of Latter-day Saints for Grand Blanc, one town 60 miles (100km) northwest of Detroit, hapun during one Sunday service, wey hundreds of pipo attend.

Police later shoot di suspect, wey dey identified as Thomas Jacob Sanford from Burton, Michigan for di church car park.

Authorities dey torchlight di incident as “act of targeted violence”, but dem say di motive neva dey clear.

Two victims bin die from di gunshot wounds, Grand Blanc Township Police Chief William Renye tell one news conference on Sunday, 28 September.

E later add say dem see say two more pipo don die and “some” odas still dey unaccounted for, though e no fit tok how many.

Dem still dey “clear” di Church on Sunday night afta e suffer big fire damage, e tok.

Chief Renye say “hundreds” of pipo bin dey attend di services at about 10:25 local time (15:25 GMT) wen one gunman drive motor into di building.

Di attacker come open fire wit one assault-style rifle, ” and fire several rounds at individuals within di church,” e tok.

Di police bin go di scene immediately, e tok and add say officers “engage for gunfire wit dat particular individual, dem neutralise di suspect”. Dem kill 40-year-old Sanford at 10:33 local time, eight minutes afta di shooting.

“We still dey try to determine exactly wen and wia di fire bin come from and how e start,” di police chief tok.

Di suspect bin use one accelerant – most likely gasoline – to start di blaze, authorities tok.

Chief Renye also hail di “heroism” of churchgoers wey e tok say hide children for di church during di incident.

Dem no support media player for your device

Investigators dey search di suspect property and dem dey examine im cell-phone records as dem dey work to establish a motive.

Records show say 40-year-old Sanford na Marine Corps veteran, di BBC US partner CBS report.

Di FBI dey lead di investigation and don deploy crisis response teams, bomb technicians plus odas to di scene, according to Reuben Coleman, di acting special agent in charge of di FBI Detroit field office.

Michigan State Police tok-tok pesin Kim Vetter tell tori pipo say officers dey respond to additional bomb threats for multiple oda locations.

“We don respond and clear those locations,” she tok.

For inside one statement, di Church of Jesus Christ of Latter-day Saints confam say na gunman open fire during worship services, and “plenti pipo injure”.

“We dey pray for peace and healing for everyone wey dey involved,” dem tok.

Grand Blanc police tok say dem don deploy 100 FBI agents to assist wit di investigation.

President Donald Trump tok say dem don brief am about di shooting, and e confam say di FBI go dey lead di federal investigation.

Writing on Truth Social, e describe am as “yet anoda targeted attack on Christians for di United States of America”.

US Attorney General Pam Bondi tok for one post on X say she bin receive di briefings on “wetin appear to be a horrific shooting and fire” for di church.

“Such violence for a place of worship dey heartbreaking and chilling,” Bondi tok.

“Please join me in praying for the victims of this terrible tragedy.”

Michigan Governor Gretchen Whitmer condemn di incident, e say: “Violence anywhere, especially for a place of worship, dey unacceptable,” and add say she dey monitor di situation.

Mitt Romney, former US senator for Utah and one of di most prominent Mormon politicians, call di shooting “tragedy”, e add say: “My brothers and sisters and dia church be targets of violence. Praying for healing and comforting.”

Get in touch

Are you in the area? If it is safe to do so, get in touch.

 

Search

RECENT PRESS RELEASES

Go to Top